Atiku Murna Ta Koma Ciki Bola Tinubu Ya Fara Dariya Domin Ya Baiwa Atiku Tazarar Ƙuri'u Miliyan Ɗaya (1) Gwamnonin Arewa Kunci Amanar Mu Wallahi Allah Zai Saka Muna.

 





Atiku Murna Ta Koma Ciki Bola Tinubu Ya Fara Dariya Domin Ya Baiwa Atiku Tazarar Ƙuri'u Miliyan Ɗaya (1) Gwamnonin Arewa Kunci Amanar Mu Wallahi Allah Zai Saka Muna.


Nigeria goment don respond to one letter wey former President Olusegun Obasanjo write to president Muhammadu Buhari, say make e cancel di Presidential/National Assembly election wey hold for di kontri on Saturday 25, February on top accuse say magomago and electoral malpractice na im full am.

Di Nigeria goment for inside one statement wey di Minister of Information and Culture, Lai Mohammed issue say di former president letter na calculated attempt to undermine di electoral process and to incite violence.

And add say make di former Nigerian leader no scata di 2023 general elections wit im inciting, self-serving and provocative letters on di election.

As di announcement of di presidential election dey go on for Abuja, di kontri capital on Monday, former President Olusegun bin issue one letter wey e address to President Muhammadu Buhari.

E tok for inside di letter say make di electoral body save di kontri from “a looming danger” over wetin e describe as corruption of di electoral process.

Di elder statesman allege say tension dey build up and e ask President Muhammadu Buhari to “cancel all di elections wey no pass di credibility and transparency test.”

However, oga Lai say di former President organize di worst election since Nigeria return to democratic rule for 1999, so e no qualify to advise President Buhari wey dey try leave beta election legacy.

Comments

Popular posts from this blog

Alhamdulillah Alhamdulillah Alhamdulillah Yanzu Yanzu Anga Jijirin Wata Ramadan a Kasar Saudiyya Gobe Insha Allahu Zamu Tashi Da Azumi Wata Ramadan Kareem Ya Allah Duk Alkhairin Dake Cikin wannan Wata Allah Ubangiji Kasadamu Dashi Sharrin Kuma Dake Cikinsa Allah Ubangiji Ya Karemu Ya Allah Kasa Muda Daga Cikin Bayinka Wadanda Kake Yan Tawa A Cikin Wannan Wata Mai Albarka Alfarmar Annabi Muhammad S 💔 A 💔 W 💔 Ameeeen Thumma Ameeeen 🤲🤲🤲